conversations
listlengths
2
2
[ { "role": "user", "content": "Wetin enter inside her?" }, { "role": "assistant", "content": "She has a reason" } ]
[ { "role": "user", "content": "Is it the money or what?" }, { "role": "assistant", "content": "Family …, she need small thing to lift the family, understand? And … Basil never gain job. … all of us still been dey find, we still dey school that time" } ]
[ { "role": "user", "content": "DELSU" }, { "role": "assistant", "content": "No, nobody know say na like this im go turn am to mean. So…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Where Basil dey now sef?" }, { "role": "assistant", "content": "Mtchew. Oboy that guy just go, na Abuja he dey o. He just go hide, he no go mtchew, for im to show" } ]
[ { "role": "user", "content": "Hello, How far? Good evening. How you dey? How your exams? No wahala. Wey that lefty nah, where una dey? Hello, you don go house? Una no get card, una go dey call; mey una flash, I go call you." }, { "role": "assistant", "content": "My dear, na so the matter heavy o...
[ { "role": "user", "content": "When me I see the thing eh, as I wan open the picture, na Basil I dey expect to see" }, { "role": "assistant", "content": "Everybody expect to see Basil near the girl. When dem just see the girl like this, eh, another guy" } ]
[ { "role": "user", "content": "Na immediately I just call you say wetin dey happen" }, { "role": "assistant", "content": "Google fit say na PTI boy again and I’m…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Fine boy Hmm mtchew" }, { "role": "assistant", "content": "You sabi, all these girls," } ]
[ { "role": "user", "content": "Nawao" }, { "role": "assistant", "content": "All this una, all these girls" } ]
[ { "role": "user", "content": "E no fit them" }, { "role": "assistant", "content": "Im own better o. Me sef I see na two of you beta. You know my guy, Roma, sorry. Hello! You know Roma nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Roma…" }, { "role": "assistant", "content": "Roma wey be say na my course mate. Roma wey did im ND here, na player im be, when he come back for HND, ah, how far nah? Bawoni? Ekuise" } ]
[ { "role": "user", "content": "Good evening" }, { "role": "assistant", "content": "So, when Roma con come back for HND, Roma come dey continue im player stuff with the other girls sorry. E come get one girl, Blessing. Blessing na im be Isoko… this thing nah mtchew" } ]
[ { "role": "user", "content": "Is like I know the girl" }, { "role": "assistant", "content": "Life" } ]
[ { "role": "user", "content": "Life, he come dey focused. Pesin wey be say Roma carry, Blessing carry Apollo from hostel come give Roma for room. Roma carry am give me, me I carry am go church village that time wey I dey use glass do exam, I carry am go church village. Na so we dey share Apollo. Can you beli...
[ { "role": "user", "content": "Roma dey, all of us dey, all of us dey like this sit down. She say this is my card for my wedding, I want you guys to come. When we open the… this thing, na formal PTI student wey dey work for… Chevron" }, { "role": "assistant", "content": "Heeeey! If na me sef, I w...
[ { "role": "user", "content": "Nooo nau" }, { "role": "assistant", "content": "But and the boy was there" } ]
[ { "role": "user", "content": "He was there. Come join mata," }, { "role": "assistant", "content": "She get mind" } ]
[ { "role": "user", "content": "She come talk say ehhhen, all of us have to come for the wedding mtchew. We just collect the card, we keep am. As she just waka go mtchew, oboy, look the guy like this" }, { "role": "assistant", "content": "That boy go cry o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Roma nah wey dey, e no dey date one girl o. any girl wey come, he just dey reason say noo he can’t love again" }, { "role": "assistant", "content": "Hei!" } ]
[ { "role": "user", "content": "The one wey you see come put you love come say you love, yes you don see true love. No be when I dey Lagos na im I dey work with nah when you come that time. When I dey go beach, dey change, you dey see, e dey send picture for this… so with me guy, guy I can’t love again" }, ...
[ { "role": "user", "content": "The guy, the guy dey Warri here now" }, { "role": "assistant", "content": "If you really love, it will take it, it will take time" } ]
[ { "role": "user", "content": "It will take time. Imagine that kind of thing" }, { "role": "assistant", "content": "Hmmm, it's killing o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Eh!" }, { "role": "assistant", "content": "Hia!" } ]
[ { "role": "user", "content": "Somebody that was something before. Ewonieleyi? Je n wo… Love letter lo nkani, ta lo n sendi e, which one?" }, { "role": "assistant", "content": "I will not go till it’s Wednesday" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wednesday, what happened, seems their hostel is not open, do you have anything… still there?" }, { "role": "assistant", "content": "Yes o, welfare still dey write exam, to sleep go dey fear am" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahhn-ahhhnn. So, you are going on,.. next tomorrow, abi? What are you bringing for me when you come back?" }, { "role": "assistant", "content": "Drinking garri" } ]
[ { "role": "user", "content": "Me garri, garri Ijebu or which one?" }, { "role": "assistant", "content": "Garri Ijebu" } ]
[ { "role": "user", "content": "Only garri Ijebu? What you got during your… interview, I never… I never forget o; when you chop alone. This girl bring something come from exam interview, she chop am alone, come talk say make I no tell her mummy, wey my phone sef, mey I even call am now" }, { "role": "...
[ { "role": "user", "content": "I no go forget o" }, { "role": "assistant", "content": "Since 2017" } ]
[ { "role": "user", "content": "I can’t forget . You and Alabi are now working hand in hand now. Which kind laugh be that, has he inject you?" }, { "role": "assistant", "content": "Who is the Bella here sef? where im go?" } ]
[ { "role": "user", "content": "You no whether dem don pay Bella school fees, Bella no dey im room" }, { "role": "assistant", "content": "Isoku wetin we go eat, I dey hungry?" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wetin you won chop?" }, { "role": "assistant", "content": "Food nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Food for where, where we go chop??" }, { "role": "assistant", "content": "Dem dey sell food for there" } ]
[ { "role": "user", "content": "You no cook for room?" }, { "role": "assistant", "content": "Na so. Make person cook this exam time. You no even dey pity person" } ]
[ { "role": "user", "content": "Exam don finish nah" }, { "role": "assistant", "content": "Exam dey and no time" } ]
[ { "role": "user", "content": "Even in our time, we use to cook, shey you know, we use to cook" }, { "role": "assistant", "content": "After the paper, I see; I no dey even see anything, na sleep, sleep dey my eyes hmm, mtcheW" } ]
[ { "role": "user", "content": "And you never chop" }, { "role": "assistant", "content": "I go sleep o, no be…" } ]
[ { "role": "user", "content": "But you know in our time we use to cook, shey you know?" }, { "role": "assistant", "content": "Because you people are super intelligent" } ]
[ { "role": "user", "content": "Nooo, na God o, we dey cook" }, { "role": "assistant", "content": "Na so. We, we are just coming up. We are trying to…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wey you dey on distinction, you tell me say you are coming up" }, { "role": "assistant", "content": "E concern you?" } ]
[ { "role": "user", "content": "Distinction. You are coming up. Na DT she dey ooo" }, { "role": "assistant", "content": "Na so. I no dey DT ooo" } ]
[ { "role": "user", "content": "No be upper you dey?" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhhen" } ]
[ { "role": "user", "content": "3.59" }, { "role": "assistant", "content": "So, chinekemo…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Abi the day of convocation now, they will give you award nah. Best graduate girl, female… SLT" }, { "role": "assistant", "content": "Hmm… I pray say…" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no say" }, { "role": "assistant", "content": "Me I no know o" } ]
[ { "role": "user", "content": "For that una class ehen, una get people wey get, we get brain o, brain dey" }, { "role": "assistant", "content": "The competition eh" } ]
[ { "role": "user", "content": "Brain too much. Uju dey, Oluchi, all of una" }, { "role": "assistant", "content": "As in" } ]
[ { "role": "user", "content": "Kai!" }, { "role": "assistant", "content": "The thing just dey like we dey in a race" } ]
[ { "role": "user", "content": "No, no, no, no. Some of una for drop enter this one, ND1, make una come dey do HND1, make e come deyyy, but all of una just come the same time" }, { "role": "assistant", "content": "Nobody won gree for anybody" } ]
[ { "role": "user", "content": "E too much from this one" }, { "role": "assistant", "content": "Oya nah, 2" } ]
[ { "role": "user", "content": "What do you say, what do we eat?" }, { "role": "assistant", "content": "Food nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Where?" }, { "role": "assistant", "content": "Dem dey sell food there" } ]
[ { "role": "user", "content": "_ Hmmm. I cannot eat all this kind of food" }, { "role": "assistant", "content": "Oya make we go ShopRite" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahhnahn, ice cream" }, { "role": "assistant", "content": "Wetin you talk" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ice cream" }, { "role": "assistant", "content": "But there’s no light<" } ]
[ { "role": "user", "content": "The, if you reach ShopRite you go see" }, { "role": "assistant", "content": "ShopRite?" } ]
[ { "role": "user", "content": "Oya, mey will go AJ" }, { "role": "assistant", "content": "I don go like this, AJ? Oya mey will go nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Oya nah" }, { "role": "assistant", "content": "Na bread we go just buy nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Which bread?" }, { "role": "assistant", "content": "Ahn, ahn, sardine bread" } ]
[ { "role": "user", "content": "I be… I be aboki?" }, { "role": "assistant", "content": "Sardine bre, no be Abuja you dey stay? No be near aboki people you dey…" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no want bread, na food I want" }, { "role": "assistant", "content": "Which food you won chop?" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no like bread" }, { "role": "assistant", "content": "E say e no like bread" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no like bread, I swear" }, { "role": "assistant", "content": "Bread go dey hang person for throat" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahn, ehhen nau" }, { "role": "assistant", "content": "Thank God s… thank God you be na my sister, my wife go know how to do, how to do bread. Bread must dey, everyday bread must dey the house" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ehhhen?" }, { "role": "assistant", "content": "Bread must dey" } ]
[ { "role": "user", "content": "Because of wetin?" }, { "role": "assistant", "content": "Ah! see, na bakery you dey see so o, if I dey go work eh, I dey carry like four Delta bread go office" } ]
[ { "role": "user", "content": "Why? And you go finish am?" }, { "role": "assistant", "content": "Yes nah. Today, e don finish" } ]
[ { "role": "user", "content": "Bright! How far nah?" }, { "role": "assistant", "content": "I just dey, you don finish" } ]
[ { "role": "user", "content": "Good evening, na so ooo" }, { "role": "assistant", "content": "How far?" } ]
[ { "role": "user", "content": "When are you leaving?" }, { "role": "assistant", "content": "I’m not leaving o, I’m around. Olori, I dey come" } ]
[ { "role": "user", "content": "No be you dey shout immediately after your paper, you are going" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhhen, all na whining, all nah whining" } ]
[ { "role": "user", "content": "That boy wey you first you go. Na Yoruba person?" }, { "role": "assistant", "content": "Like seriously" } ]
[ { "role": "user", "content": "Your set too small, no be say… the guy is large" }, { "role": "assistant", "content": "Na so" } ]
[ { "role": "user", "content": "OND? God forbid. PT, PTI no tall, all these shanku, shanku, shankulu boys come dey dey position" }, { "role": "assistant", "content": "As in…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Where are the big boys?" }, { "role": "assistant", "content": "E tire me o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Cult no dey school again, cult no dey" }, { "role": "assistant", "content": "Yes. Cult dey hostel" } ]
[ { "role": "user", "content": "But na small, small boys na in dey now Our own time na ma…" }, { "role": "assistant", "content": "All these ND1" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ehhen, our own time na matured men be cultist that time nah. Dem go even see their eyes sef, you go fear<CS>" }, { "role": "assistant", "content": "Hmmm. This one when im slap you, nothing you won do o" } ]
[ { "role": "user", "content": "For this school?" }, { "role": "assistant", "content": "You go just tell am sorry waka go" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ah, nooo mtchew, but it’s good sha. All this things, there is no, no gain but they can’t know now, when they leave the system" }, { "role": "assistant", "content": "They can’t know sha" } ]
[ { "role": "user", "content": "They can’t know" }, { "role": "assistant", "content": "Is when they leave that they will know that they are living in risked life" } ]
[ { "role": "user", "content": "You know what gave them the power, privilege now, because they are seeing themselves everyday" }, { "role": "assistant", "content": "Yeah" } ]
[ { "role": "user", "content": "When you leave school now, some will go Ijebu, you will go Abuja, before you go call any of your mate, hmm, you go know say ah, for this cult wey I join, e no help me o…" }, { "role": "assistant", "content": "Yes o" } ]
[ { "role": "user", "content": "E no help me o but now because Orji, Orokpa, they are rolling, doing everything together mtchew but if anything won sup, he go call this one. No worry, no worry. So, Olori wetin you won chop?" }, { "role": "assistant", "content": "You always decide it nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "You always decide it. Mey we go cook nah, mey will go cook, mey we go cook rice, mey we go cook . Ahn, kai, no swallow me nahhh, Olori" }, { "role": "assistant", "content": "P/P Hmmm… ice cream" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ice cream, dem no dey sell ice cream here nah. Izu, izuoma dey sell ice cream?" }, { "role": "assistant", "content": "ShopRite" } ]
[ { "role": "user", "content": "Oya, let’s go" }, { "role": "assistant", "content": "Stand up nah make we dey go" } ]
[ { "role": "user", "content": "Make una go bring cab come. Na motor una won carry ni?" }, { "role": "assistant", "content": "If we reach ehhhhenn… main road…I go see cab, keke" } ]
[ { "role": "user", "content": "_ When you dey travel sef?" }, { "role": "assistant", "content": "Thursday" } ]
[ { "role": "user", "content": "How many times you don ask me?" }, { "role": "assistant", "content": "I don forget nah, many things dey my head. Thursday" } ]
[ { "role": "user", "content": "Thursday" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhen, we go on sunday, we will go ShopRite on Wednesday, tomorrow. Ask her, no, ask her, she knows, ask her. She get date tomorrow, ehhen…Shake me, I understand. shake me nah Olori" } ]
[ { "role": "user", "content": "How is Victor?" }, { "role": "assistant", "content": "I want to see Queen tomorrow okay? you hear?" } ]
[ { "role": "user", "content": "To see what? God forbid! Ah but i…" }, { "role": "assistant", "content": "I’ve not even seen your King sef. Abeg mey I see your King. Mey I see im picture. Na im dey here? Which one? This one? This short one?" } ]
[ { "role": "user", "content": "This one come be?" }, { "role": "assistant", "content": "Show me the picture nah. Mey I see im picture. Shey two of una no snap together? This girl no serious, she hold the …, she first see the … Why una no snap together?" } ]
[ { "role": "user", "content": "It’s okay nah" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhen, mey I see nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Dem been snap together nah" }, { "role": "assistant", "content": "Eheen, mey I see nah. Una for sweet, if una marry, una go just do wedding, Everything. If to say eh Sorry, as you don talk say eh, that means you no fit think. Sit down, sit down, sit down, you no fi...
[ { "role": "user", "content": "I no see you?" }, { "role": "assistant", "content": "Abeg. This your friend Anonymous, you dey hear from am? Ah, she don leave oil Ogun State goo. Na Warri people she dey carry now like Daniel and co, all those ones. We no dey call am Anthonia again. Anthoniana big ...
[ { "role": "user", "content": "Abeg make this thing comot, ah" }, { "role": "assistant", "content": "So tomorrow is a suffer day for only me. I won go out Tomorrow nah when we go." } ]
[ { "role": "user", "content": "Okay" }, { "role": "assistant", "content": "Tomorrow is Wednesday, abi? Hmmm. But tell the person that once they call you, we can eat the whole money till 3:30, 4 we will…" } ]
[ { "role": "user", "content": "You no see her? you’ve seen her?" }, { "role": "assistant", "content": "Okay that one, okay that one. I might not understand. Anytime you finish nah, let me know. You dey go ShopLeft, abi?" } ]